Gbajabiamila Press Yans Dat Education Na Mission For Renewed Hope Agenda
By: Esther Ayoola Chief of Staff to oga Presido, Femi Gbajabiamila, don repeat tuks, say education na key part of President Bola Tinubu Renewed Hope Agenda. Im yarn dis one for Abuja during 2026 International Day for Education Conference wey Speaker Tajudeen Abbas organise. Gbajabiamila say if Naija wan compete well for global knowledge economy, e must invest serious for education and carry young people along.