One 500-level Building Technology student for Covenant University, Ogun State, Toluwase Jesutunmise, don kpai as im dey jim jim bodi for campus.
For statement wey University Vice-Chancellor, Professor Timothy Anake release on Wednesday say di late student bin dey train before e comot, go rest afta e complain of leg pain and fatigue.
Di VC add say few moments later, im teammates notice say e dey gasp for air, come rush am go di university medical centre wey dey opposite di field.
However, dem say e don stop to breathe before dem reach di medical centre.