Northern Govos Package Security Matas Condem Jos Attack
By: Esther Ayoola Di Chairmo of Northern States Governors’ Forum, Gombe State Govo, Inuwa Yahaya, don condemn di attack wey hapun for Angwan Rukuba, Jos North, Plateau State. Im yan dis one afta dia quarterly meeting for Abuja. Governor Yahaya yan say di governors tuk about security mata for North and dem agree to tackle di gbege wey dey affect di north.