Passenger Kpai Inside Kenya Airways Plane Wey Dey Come Lagos
By: Mariam Ajayi One Kenya Airways plane wey bin dey come Lagos from Nairobi, say from no wia, person just kpeme for plane as hin near Lagos. Nobody sabi wetin kill di man. According by infomate wey di airline tok tok person, Michael Achimugu, bring out, di passenger just stop to respond about 20 minutes before di plane land and dem try first aid, kpokrikpor, di man don go, otilor. […]