Make Una Shine Eye Well Well For Fake And Expired Products – LASCOPA
Lagos State Consumer Protection Agency (LASCOPA) don warn Lagosians say make dem shine eye well well, as Easter dey come, say chances of people to cheat and sell bad market dey high for dis period. For statement wey dem drop for dia X page on Thursday, General Manager, Afolabi Solebo, talk say make consumers stay sharp as buying and selling go increase. E say make people careful because price fit […]