Lazio Coach Sarri Do Small Heart Operation
By: Esther Ayoola Lazio coach Maurizio Sarri don undergo small heart operation afta doctors find say im get atrial fibrillation wey dey affect heart rhythm. Di Serie A club talk say di operation be routine and dem expect di 66-year-old manager to resume work in few days. For statement wey dem post for X, Lazio confirm say Sarri do transcatheter ablation for Policlinico Tor Vergata hospital.