By: Esther Ayoola
Lazio coach Maurizio Sarri don undergo small heart operation afta doctors find say im get atrial fibrillation wey dey affect heart rhythm.
Di Serie A club talk say di operation be routine and dem expect di 66-year-old manager to resume work in few days.
For statement wey dem post for X, Lazio confirm say Sarri do transcatheter ablation for Policlinico Tor Vergata hospital.