UAE Clear Air Say No Secret Visit From Netanyahu
By : Jolayemi Olajide United Arab Emirates don deny report say Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu do “secret visit” enter di country during war wey involve US and Israel against Iran. For statement wey dem wrap like moimoi naim di UAE state news agency WAM dey clear dis mata say dia relationship wit Israel dey open. UAE gornment still maintain say all their engagement wit Israel dey public and transparent.