Super Eagles Buy Waka Marrakesh For AFCON Quarterfinal
By: Esther Ayoola Nigeria Football Federation don confamate say Super Eagles go comot Fez go Marrakesh on Thursday as dem dey prepare for Africa Cup of Nations quarterfinal. Dem go face Algeria for match on Saturday by 5pm. According NFF post on X, say All 26 available players join training on Tuesday evening for Sardienne Complex. Defender Ryan Alebiosu still dey sidelined as e dey recover from injury.