Oyo Gorment Promote Assembly Member, Ali And Two Chiefs, To Become Big Obas
Di Oyo State Gorment on Thursday, don approve say National Assembly member wey dey represent Oyo South, Sharafadeen Alli, plus High Chiefs Bolaji Adewoyin and Kola Babalola, go become Obas for Ibadan land. Di Commissioner for Local Gorment and Chieftaincy Matas, Ademola Ojo, konfam dis promotion inside memo wey gornment release for Ibadan. Dem promote Alli go Ekerin Olubadan, Adewoyin go Ekaarun Balogun, while Babalola go Ekarun Olubadan. Di gorment […]