NPFL

11 Results / Page 1 of 2

Background

Sports

Shakiru Giwa Comot As Inter Lagos Coach

By: Jolayemi olajide Shakiru Giwa don comot as head coach of Inter Lagos for Naija Premier Football League, NPFL. Di Lagos club announce di news for dia X account on Tuesday, October 13, 2026, confirm say Giwa no dey in charge of di team again. Giwa na di first coach wey comot im position dis season, but Inter Lagos no talk wetin make am leave. Di club thank am for […]

todayOctober 13, 2026 6

Sports

Kayode Oke Score Goal After 18 Seconds

Kayode Oke, wey dey play for Bendel Insurance, score di quickest goal for dis season NPFL as e put ball for net just 18 seconds after match start against Sporting Lagos for Mobolaji Johnson Arena, Onikan, Lagos. Even though Oke give im team early lead, Bendel Insurance no fit maintain di lead as Sporting Lagos fight back to win di match 2-1. Victor Samuel score di equaliser for Sporting Lagos […]

todayOctober 12, 2026 8

Sport Yarns

Shooting Stars Striker Ayodele Set to Dump NPFL for Egypt Move

By: Jolayemi Olajide   Shooting Stars striker Ismail Ayodele dey close to leaving di Nigeria Premier Football League side after Egyptian club Modern Sports SC reach agreement to sign am. Reports say di player don agree personal terms with di Egyptian team and e go travel go Northern Africa to complete di final stages of di contract. Ayodele, wey play regularly for di Oluyole Warriors last season, score four goals […]

todayAugust 6, 2026 24

Sports

Kano Pillars Release Eight Players

Kano Pillars Football Club don announce say eight players go leave dia club as dia contracts expire for end of 2025/2026 NPFL season. Di players include Muhammad Galadima, Ugochukwu Gabriel, Zahraddeen Bello, Williams Ayuba, Bernard Ovoke, Christian Izuchukwu, Sudais Ali Baba, and Aliyu Yakubu. For statement, di club thank dem for dia professionalism, commitment and contribution while dem dey play for Kano Pillars. Di club wish dem well for dia […]

todayJune 16, 2026 24

Sports

Former Super Eagles B Midfielder Explain Why Players Dey Japa Go Anyhow Countries

Former Super Eagles B midfielder Ifeanyi Ifeanyi don scata mouth say Nigeria premier football league dem nor dey pay well, na im make players dey take risk go countries wey nobody sabi E tuk dis one for interview with journalist, as im dey explain how life be for am since e move go play football for Iraq. According to am, di reason why people dey fear na because nobody really […]

todayMay 1, 2026 21

Sports

Remo Stars Nail 3SC, Kano Pillars Hammer Bendel Insurance 4-0

Interesting games na sup for di Nigeria Premier Football League, match day 33, say Remo Stars record 1-0 win over Shooting Stars for Ikenne on Sunday as Samuel Anakwe score di only goal after half-time. For other matches, Kano Pillars hammer Bendel Insurance 4-0, while Kwara United waka pass El-Kanemi Warriors 3-0. Rivers United lose 2-0 to Warri Wolves as Nasarawa United collect 0-1 lose to Kun Khalifat.

todayApril 6, 2026 24

Sports

NPFL Match Day 32, Niger, Ikorodu, Bayelsa, Rivers Collobi Big Wins

By: Esther Ayoola Na correct football action happen for NPFL Match Day 32 on Sunday. Niger Tornadoes knack Wikki Tourists 2-0, while Ikorodu City shock Warri Wolves 4-3. Bayelsa United crush Kano Pillars 4-1, and Rivers United waka pass Kun Khalifat 4-2. Some games end draw, like El-Kanemi Warriors 1-1 Remo Stars, Barau FC 0-0 Katsina United, and Bendel Insurance 2-2 Plateau United.

todayMarch 30, 2026 31

Sports

NPFL Match Day 31: Katsina, Kano, Remo, Rangers Record Win

For Sunday matas, the NPFL nor dey slack at for match day 31  as top teams  fight for points. Katsina United FC beat Shooting Stars FC 1-0, while Kano Pillars FC show power with 2-0 win over Enyimba International FC. Remo Stars FC carry 3-1-win comot for Kwara United FC, and Enugu Rangers FC waka go 2-0 against El-Kanemi Warriors FC. Some games like Warri Wolves FC vs Bendel Insurance […]

todayMarch 23, 2026 27

Sports

Ikorodu City Enter Top Of NPFL Beating Niger Tornadoes

By: Esther Ayoola Ikorodu City don climb di top of Nigeria Premier League table afta beating Niger Tornadoes 2–0 for home on matchday 25. Joseph Arumala na him score both goals wey carry Oga Boys reach 41 points, level with Rivers United and Nasarawa United but dem dey ahead on goal difference. Inside di beta support for Mobolaji Johnson Arena, Ikorodu control di game and show say dem be title […]

todayFebruary 9, 2026 40

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds