PFIPC

4 Results / Page 1 of 1

Background

OBODO NAIJA

State House Deny PFIPC Letters, Reps Begin Investigation

By Oluwatosin Ibrahim State House Director of Administration, Abdullahi Idris, on Thursday tell House Ad hoc Committee for Abuja say letters linked to di Presidential Foreign Intervention Promotion Council, PFIPC, na fake and no such department or official exist for State House. Idris explain say di letters carry fake signature and fake office title, while records show say nobody called Akanbi Adewale ever serve as Director of Administration for State […]

todayAugust 7, 2026 10

OBODO NAIJA

Businessman Say Him Pay Fake PFIPC DG ₦400 Million

By: Olabisi Olatunji Managing Director of Divine Dopacy Nigeria Limited, Gbenga Collins, don tell House of Representatives committee say him pay ₦400 million to Adeniyi Adeyemi after promise of contract. Collins tok dis one on Tuesday as lawmakers dey investigate di alleged operations of di Presidential Foreign Investment Promotion Council. According to am, him believe say di agency na real because Adeyemi dey use Federal Secretariat office for Abuja, security […]

todayAugust 5, 2026 6

OBODO NAIJA

CBN Admit Say Dem Open Dollar, Pound Accounts for Alleged Fake Presidency Council

By: Esther Daniel Di Central Bank of Nigeria (CBN) don confirm say e open two foreign currency account for presidential foreign investment promotion council(PFIPC) Di confirmation come on Monday during House of Representatives public hearing for Abuja. CBN tuk say dem open di accounts after dem receive instruction from di Office of di Accountant-General of di Federation. Meanwhile, Oga Tinubu Chief of Staff, Femi Gbajabiamila, appear before ICPC to give […]

todayJuly 21, 2026 18

OBODO NAIJA

Court Order Make Police Arrest Self-Claimed PFIPC Oga Adeyemi

By : Jolayemi Olajide Justice Muhammed Umar of Federal High Court for Abuja don order make police arrest Adeniyi Adeyemi after e no show for court to answer the charges against am. Adeyemi, wey dey call himself Director-General of Presidential Foreign Investment Promotion Council, suppose take plea for eight-count charge wey involve forgery, fraud and impersonation. Even though one lawyer, Genesis Francis, appear for am, the defendant no come court […]

todayJuly 14, 2026 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds