FG Announce Ogbonge $1bn Funds Wey Dem Wan Use Help Poor Pipo
By: Yusuf Abuh Federal Gornment don launch $1 billion Renewed Hope Social Protection Programme to help poor Nigerians. First Lady Oluremi Tinubu, AKA iya Alakara naim porporly dis mata on Wednesday for Presidential Banquet Hall, State House, Abuja, say dis project wey dem call HOPE-SP go helep create ogbongelicious small businesses for country man and woman. Iya Oluremi say di programme go listen to di specific needs of poor families […]