Presido Tinubu Order 100,000 CNG Kits To Make Transport Cheap
Wi oga Presido Bola Tinubu don wire message say make dem deploy 100,000 CNG conversion kits for next two to three weeks as option to di hike of petrol price. Dis one dey come after meeting for State House, Abuja with Ismaeel Ahmed, Chairmo of Pi-CNG. Say, Tinubu wan make CNG dey everywia, so dat transport go cheap for Nigerians.