UN Vote Say Slave Trade Na Biggest Crime In History
By: Esther Ayoola Yesterday for UN headquarters for New York, UN General Assembly vote say, transatlantic African slave trade na “di biggest crime against humanity.” Ghana propose di motion, and 123 countries gree to am. USA, Israel, and Argentina oppose di vote, while UK and all 27 EU countries watch hand comot. Untop yarnings with tori pipo afta di meeting, Ghana Presido, John Mahama tell reporters say e dey support […]