Presidential Fiscal Policy and Tax Reforms Committee don deny report wey tuk say Minister of State for Finance Taiwo Oyedele admit say new tax law get error.
Dem tuk say, di news misrepresent wetin di minister actually tuk during fireside chat for Nigerian Bar Association Section on Legal Practice conference for Lagos.
Dem sti clear say e no tell pipo make dem dey wait for any legislative probe, as certified and gazetted copies of di law, dem don already publish am since January 2026.
Di committee warn say dis kind misleading story fit confuse public, as dem also highlight say reforms don increase CAC registration for informal businesses and raise taxpayers from about 10 million to over 100 million.