Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Esther Ayoola
Wi oga Presido, Bola Tinubu don approve new appointments for key education agencies.
Dis na according to a statement by im media aid, Bayo Onanuga tuk on Wednesday for Abuja.
According to am, dis move na to strengthen institutions under Federal Ministry of Education and improve how dem dey run.
Tinubu appoint Prof. Modupe Adeola Adelabu as chairmo for National Examinations Council board, while Prof. Ibrahim Wushishi go sti remain as registrar, and Prof. Babatunde Salako become chairman for National Board for Technical Education.
E also confirm say Prof. Idris Bugaje don already get second and final five-year term as executive secretary, as part of effort to ensure continuity and better management for di agencies.
Written by: News Author
education in Nigeria federal education agencies NBTE leadership NECO leadership NIGERIA EDUCATION REFORM Tinubu appointments Tinubu education policy
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2026