National

Tinubu Pick Ex-Cds Musa As New Defence Minister After Badaru Quit

todayDecember 2, 2025 10 1

Background
share close

By: Alice Iduh

Presdo Bola Tinubu don drop fresh nomination as e pick former Chief of Defence Staff, General Christopher Musa, to take over Defence Ministry after Mohammed Badaru step down on Monday.

Na through letter wey presdo send give Senate Presdo Godswill Akpabio for Abuja, dem take announce di new pick and confirm say Musa na di man to run Defence waka next.

General Musa,wey be 58 years old, serve as CDS from 2023 reach October 2025, and di man no be today soldier im even win the Colin Powell Award for Soldiering back for 2012.

Born for Sokoto in 1967, Musa school for there, later enter College of Advanced Studies Zaria, graduate 1986, join NDA same year, and bag B.Sc. for 1991, before climb reach dis new national assignment.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app