Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
President Bola Tinubu don urge Super Eagles make dem recover di lost glory by win di 2025 African Cup of Nations (AFCON) wey go hold for Morocco. Di president encourage di team on Monday, according to statement wey him Special Adviser on Information & Strategy, Bayo Onanuga, release. Onanuga talk say Tinubu commend di Super Eagles for dia best effort wey dem put for 2026 FIFA World Cup qualifier, even though dem lose di playoff on Sunday. Tinubu don charge di Eagles make dem forget di loss to Democratic Republic of Congo and focus on AFCON wey go hold from December 2025 to January 2026 for Morocco. Nigeria World Cup dream don finish as Congo DR elimanate Super Eagles in penalty shootout after 1-1 draw for extra time; DR Congo win 4-3 for penalties.
Onanuga add say President Tinubu talk say e pain make Eagles fail qualify for World Cup tournament second consecutive time, but di players still deserve commendation for dia effort, especially after dem win dia first playoff match. Tinubu talk say make everybody go back to drawing board, plug loopholes, and focus all energy on AFCON. Di Super Eagles dey for Group C with Taifa Stars of Tanzania, Cranes of Uganda, and Carthage Eagles of Tunisia. Di team last win AFCON for South Africa 2013 under late coach Stephen Keshi, wey also win di trophy as captain for Tunisia 1994. Nigeria first AFCON win na 1980 when Green Eagles beat Algeria 3-0 for National Stadium, Surulere, Lagos. Dem still reach final of 2023 AFCON for Ivory Coast last year but lose 2-1 to host nation, even though captain William Troost-Ekong score powerful header.
Written by: News Editor 1
AFCON 2025 news AFCON tournament Nigeria Nigeria football AFCON 2025 Super Eagles AFCON Super Eagles motivation
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025