National

Tinubu Wire Letter Give Senate Say Im Wan Send Army Go Benin Republic

todayDecember 9, 2025 3

Background
share close

By: Alice Iduh

Wi oga Presido Bola Tinubu don write Senate say,  make dem allow am send Naija soldiers go Republic of Benin as di country ask for help after coup wahala wey bust on sunday.

Oga Senate Presido, Godswill Akpabio, read di letter for plenary, and Tinubu talk say na section 5(5) of di 1999 Constitution give am power to seek dis kind approval.

Tinubu yarn say Benin beg for backup as dem be sister country, and Naija no fit turn face since friendship and brotherhood strong.

Dis move follow di drama wey Lt Col Pascal Tigri and him “Military Committee for Refoundation” take seize Benin state TV on Sunday before fighter jets and troops wey Tinubu deploy scatter di coup attempt.

 

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app