National

UK Link Nigeria, Others to Poison Alcohol Drinks

todayOctober 22, 2025

Background
share close

Di UK Foreign Office don add Nigeria and seven other countries join warning list wey dey alert travellers about di danger of methanol poisoning from fake or contaminated alcohol drinks. Di other countries wey join Nigeria for di list na Ecuador, Japan, Mexico, Peru, Russia, Uganda and Kenya. Dis update enter dia travel advice after wahala wey involve some Britons wey don jam problem for those countries. Before now, di warning bin cover places like Thailand, Laos, Vietnam, Cambodia, Indonesia, Turkey, Costa Rica and Fiji, especially after six tourists kpai for Laos last year.

Di UK Foreign Office don talk say travellers suppose shine eye for signs of methanol poisoning like blurry vision, confusion, vomiting and dizziness – all of dem fit lead to serious sickness or even death. Methanol na dangerous industrial chemical wey dey inside things like antifreeze and windscreen cleaner – e no be wetin human being suppose drink. But some greedy backyard brewers and bar people dey mix am inside drinks to save money. UK don warn make people buy only sealed bottles from licensed places, avoid homemade alcohol, pre-mixed spirits, cocktails and anything wey dem serve for jug or bucket.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app