International

Us Drag Mata Go Seize Oil Tanker Near Venezuela

todayDecember 11, 2025 5

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Dem say trouble dey sleep yanga dey go wake am, US don seize one big oil tanker wey dey near venezuela,  na oga  Donald Trump dey yarn dis one on Wednesday, and dis one don dey make tension with caracas rise.

Untop yanings with tori pipo for im yard, Trump yarn say na di biggest tanker wey dem don ever seize, but e no give any more details.

Report talk say US don still send warships and do strike for alleged drug boats for di area, wey don kill at least 87 people, showing say Washington dey take serious action.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app