National

US Humanitarian Group Land Southern Kaduna To Check Public Hospitals

todayFebruary 10, 2026 2

Background
share close

By: Esther Ayoola

Senator wey dey represent Kaduna South, Sunday Katung, don carry one humanitarian group from America, Project C.U.R.E., to checkmate some public hospital for Southern Kaduna.

Katung say di team, wey Rose Polycarp, wey be registered nurse from US dey lead, come assess how health facilities and services dey work for Kaduna.

Say Dem don already visit Kagarko General Hospital, Kachia General Hospital and General Hospital Gwantu, while Zonkwa General Hospital and Sir Patrick Ibrahim Yakowa Hospital for Kafanchan still dey wait dem.

Di senator say di assessment very  importankpa because e go show di real condition of di hospitals and where government need quick intervention.

Written by: News Author

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app