Sports

Wetin ‘Silly’ Ronaldo Tell Me After E Red Card – Hallgrímsson

todayNovember 14, 2025 10

Background
share close

Republic of Ireland coach, Heimir Hallgrímsson don yarn wetin ‘silly’ Cristiano Ronaldo talk to am after di Portugal captain collect red card for di FIFA 2026 World Cup qualifier match wey dem play on Thursday.

Reports say Troy Parrott score two goals make Ireland beat Portugal 2-0 for Aviva Stadium, Dublin, to still keep hope for World Cup qualification alive. Portugal hope for comeback spoil after Ronaldo comot for pitch after 62 minutes. Di Al-Nassr forward hit Ireland defender, Dara O’Shea, with elbow after dem fight small. Ronaldo first collect yellow card, then dem see am dey mock O’Shea with crying gesture before referee Glenn Nyberg check am again with VAR. Di yellow card turn red, wey mean say e no go play di last Portugal qualifier against Armenia on Sunday. Hallgrímsson talk for post-match interview say, “E complimented me with putting pressure on di referee, but listen, e no concern me; na im own action for pitch make e collect red card. E no concern me unless I dey enter im head. E talk so as e dey waka comot. E talk say na clever thing to do. E dey blame referee or whoever, but na im silly decision to attack our player.”

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app