By: Ayobami Dada
Civil servants under Joint National Public Service Negotiating Council(JNPSNC), Trade Union Side, don write President Tinubu say hunger and hardship don squeeze workers tire, make government move fast.
Dem dey ask government make petrol price drop to N500 per litre, give workers Wage Award, plus add money to dia salary and allowances.
Dem also want government set up committee to sit down negotiate new National Minimum Wage of N500,000 before January 2027.
Workers say petrol price wey don climb reach N1,430 per litre and above for some places don make everything cost pass, and e dey squeeze workers and dia families well-well.