Sports

10-Man Rangers Take Work on MC Alger 2 Kondo

todayOctober 19, 2026 3

Background
share close

Rangers International of Enugu beat Algerian club MC Alger 2-0 inside di first leg of dia CAF Champions League second preliminary round match for Abeokuta.

Di Nigerian team play with 10 men from di 13th minute after dia goalkeeper, Lucky Jimoh, collect red card say hin  wunjure MC Alger player Zakaria Naidji.

Despite di red card, di Flying Antelopes wait till late inside di match before Kenneth Igboke score penalty for di 84th minute to give dem lead.

James Emo con score second goal three minutes later to secure di big win for Fidelis Ilechukwu side before dem go travel go Algeria for di return match.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds