Sports

2026 WCQ: Lesotho No Dey Fear Super Eagles – Captain, Moerane

todayOctober 10, 2025 4

Background
share close

Captain of Crocodiles of Lesotho, Sekhoane Moerane don talk say dem no dey fear Super Eagles of Nigeria. Leslie Notsi and him boys go face di three-time African champions for 2026 FIFA World Cup qualifier wey go shele for New Peter Mokaba Stadium, Polokwane, on Friday (today). For November 2023, Lesotho bin hold Nigeria to 1-1 draw for matchday one.

Even though di Crocodiles don already comot from World Cup qualification waka after dem gather only nine points from eight games, Moerane still yan say dem go enter di match with bold mind. “As we dey go into tomorrow match, we no go show fear, because wetin we suppose do be say make we no dey fear our opponents, but we go still give dem respect,” na so Moerane take talk for press conference.

 

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app