Captain of Crocodiles of Lesotho, Sekhoane Moerane don talk say dem no dey fear Super Eagles of Nigeria. Leslie Notsi and him boys go face di three-time African champions for 2026 FIFA World Cup qualifier wey go shele for New Peter Mokaba Stadium, Polokwane, on Friday (today). For November 2023, Lesotho bin hold Nigeria to 1-1 draw for matchday one.
Even though di Crocodiles don already comot from World Cup qualification waka after dem gather only nine points from eight games, Moerane still yan say dem go enter di match with bold mind. “As we dey go into tomorrow match, we no go show fear, because wetin we suppose do be say make we no dey fear our opponents, but we go still give dem respect,” na so Moerane take talk for press conference.