Sports

2026 WCQ: We Go Do Our Best To Beat Benin – Troost-Ekong

todayOctober 14, 2025 3

Background
share close

Super Eagles captain, William Troost-Ekong don talk say di players dey fully ready and dem go give everything to collect maximum three points against Benin Republic Cheetahs. Di 2026 FIFA World Cup qualifier go shele today for Godswill Akpabio International Stadium, Uyo, as Nigeria prepare face dia neighbours for matchday 10 battle. As e be so, Nigeria dey third for Group C with 14 points from nine matches, and dem must beat Benin plus hope say South Africa go drop points against Rwanda to qualify.

As Troost-Ekong take talk for press conference, he admit say qualification no fully dey for dia hand, but dem go fight hard to win. “Some players dey here wey wan make name for demself, and others wey wan enter history book. So dem ready well and go play to win,” he yarn. “Tomorrow fit no dey 100 per cent for our hand, but we go try do our best and win di match.”

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app