Entertainment

Regina Daniels Mama Talk Say Ned Give Police Money Make Dem Beat Her Pikin

todayNovember 4, 2025 21 2

Background
share close

Actress Regina Daniels’ mama, Rita Daniels, don cry come out say billionaire senator, Ned Nwoko, give police money make dem beat her pikin dem. Di woman raise alarm say her children don dey suffer for police hand for over seven hours as she beg Nigerians make dem come to her rescue. Dis wahala start after Regina Daniels herself come out accuse her husband, Ned Nwoko, say him send police go arrest her elder brother and sister because she refuse go back to am or enter rehab for alleged substance wahala.

For di viral video wey dey circulate, Rita Daniels talk say, “Nigerians, come and help me. Senator Nwoko give dem money to beat my son to stupor. This na abuse of power.” People wey dey around talk say police even shoot tear gas to scatter crowd wey gather for di station. Di matter don spark serious reactions online as many Nigerians dey blast Ned Nwoko for di alleged use of force against Regina Daniels family.

 

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds