Legendary Nollywood actor and veteran broadcaster, Chief Pete Edochie, don kpeme for di age of 79.
According to report wey reach our left ear, d i Anambra-born icon kpeme around 12:30am early dis Wednesday morning, for Enugu after e battle prostate cancer for long time.
Im son, Leo Pete Edochie, naim konfamate di sad news inside statement on behalf of di family on Instagram, where e describe di late actor as beloved husband, papa, and kinsman from Akamnato, Ifite Nteje for Anambra State.