obodo oyinbo

21 Childrensis Kpai As School Bus Crash For Uganda

todayJuly 17, 2026 2

Background
share close

By: Esther Daniel

At least 20 pikin and one adult don kpai after one school bus carry students from excursion lose control and crash for Uganda.

Police tok say di bus wey dey return from Sipi Falls comot from road, hit one big stone before e turn upside down.

Three adults and several pikin still get wunjury, and dem dey receive treatment for hospital as police continue investigation.

Road accidents involving buses still dey happen often for Uganda because of poor road condition and other safety challenges.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds