obodo oyinbo

41 Pipu Kpai As Boat Turn Upside Down For DRC

todaySeptember 25, 2026 6

Background
share close

Nor be small shege Congo dey see, today Ebola tomorrow askident.

Water just swallow one boat for Lake Tanganyika for Democratic Republic of Congo, kpai kpai at least 41 pipo, while 49 pipo manage escape.

Dis latest badness for Congo don dey make pipu dey ask whether, spiritual problem Congo dey face so, as dia village pipu nor wan allow anybody rest for bad news.

According to gbeboro doings,  say dis boat go carry overload, 100 passengers plus heavy-heavy cargo say dem dey  travel from Tanzania go Kalemie.

Provincial transport minister, Norris Mulongoyi, Naim konfamate dis badness, say, like dis  rescue team dey inside water like fish, dey still  find who dem go rescue.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds