Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don land for Port Harcourt Airport today, just two days after President Bola Tinubu lift di State of Emergency wey dem declare for the state on Wednesday evening, October 17, 2025.
Governor Fubara, wey come back with him deputy, Prof. Ngozi Odu, and him wife, Valerie Fubara, touch ground for Domestic Wing of Port Harcourt International Airport, Omagwa, around 12:19pm for private jet. As dem land, Fubara come down greet supporters plus some elders and statesmen wey come welcome am. Di governor no just remain for VIP lounge, him waka come outside to hail and appreciate the hundreds of Rivers people wey full the airport gate dey cheer am. As at di time wey we dey file this report, Gov Fubara convoy don move enter Government House, Port Harcourt, and e possible say e go address di state later today.