Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Rivers State Governor, Siminalayi Fubara, don land for Port Harcourt Airport today, just two days after President Bola Tinubu lift di State of Emergency wey dem declare for the state on Wednesday evening, October 17, 2025.
Governor Fubara, wey come back with him deputy, Prof. Ngozi Odu, and him wife, Valerie Fubara, touch ground for Domestic Wing of Port Harcourt International Airport, Omagwa, around 12:19pm for private jet. As dem land, Fubara come down greet supporters plus some elders and statesmen wey come welcome am. Di governor no just remain for VIP lounge, him waka come outside to hail and appreciate the hundreds of Rivers people wey full the airport gate dey cheer am. As at di time wey we dey file this report, Gov Fubara convoy don move enter Government House, Port Harcourt, and e possible say e go address di state later today.
Written by: News Editor 2
Fubara Returns Governor Arrival Political Support Port Harcourt
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025