National

Stray Bullet Don Wipe Osun Graduate After NYSC Call-Up

todayOctober 3, 2025 5

Background
share close

One fresh graduate from Osun State College of Technology, Esa-Oke, wey people sabi as Taoreed, don kpai after stray bullet jam am during cultists wahala for di area. Di gbege happen on Tuesday, September 23, just after di guy collect im NYSC call-up letter from school.

Eyewitnesses talk say di wahala start di previous day, Monday, September 22, when rival cult groups begin fight near di school gate as final-year students dey do their sign-out celebration. Gunshots bust everywhere, people run scatter. One final-year student die that Monday. Next day, Taoreed wey just collect him call-up letter dey wait enter bus go house along Ilesa–Esa-Oke Road when cultists come again for reprisal. Dem begin shoot, and stray bullet catch am. E run go hide for bush but no know say bullet don enter am. Dem later find am inside bush with black cross bag wey contain im NYSC letter, but e don already kpai. Police PRO, DSP Abiodun Ojelabi, confirm say na cult clash kill two students, one die on di spot, another for hospital. Dem say dem dey work to catch di bad guys wey cause di gbege.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app