Presido Bola Tinubu don conclude im visit to Saudi Arabia, where e and members of im delegation get special opportunity to enter inside Holy Kaaba to pray and perform Umrah.
Tinubu express gratitude to Saudi Arabia King, Salman bin Abdulaziz Al Saud, and Crown Prince Mohammed bin Salman for granting dem di privilege and giving dem warm welcome and hospitality.
E say di gesture show di strong relationship wey dey between Nigeria and Saudi Arabia, based on faith and friendship.
Tinubu also reveal say e use di opportunity to pray for peace, unity and prosperity for Nigeria and all Nigerians.