Flying Eagles head coach, Aliyu Zubairu, don talk say him team ready for war against Argentina. Di seven-time African champions go face Argentina for Round of 16 match for 2025 FIFA U-20 World Cup wey go happen for Santiago on Wednesday. Argentina don win all dia three group games and carry 100 percent record enter di knockout stage. Nigeria manage waka enter knockout round as one of di best third-placed teams. Even though di task heavy, Zubairu still get hope say dem go pass di test.
“Every game na new challenge, and we go prepare with same mentality, focus, discipline, and teamwork,” na wetin Zubairu talk after Nigeria qualification. He add say, “We respect Argentina, but na challenge wey we must overcome.” Remember say na Flying Eagles send Argentina comot for Round of 16 for di last edition of di tournament.