Di Flying Eagles of Nigeria dey prepare for one hot Round of 16 showdown with tournament ogbonge favourites Argentina for di ongoing FIFA U-20 World Cup wey dey shele for Chile. Di match go happen on Wednesday, October 8, 2025, by 8:30 PM Naija time. Fans fit watch am live for DStv (SuperSport), StarTimes, FIFA+ and beIN SPORTS.
Argentina don dey para for dis tournament as dem top Group D with three wins from three, dem beat Cuba 3-1, destroy Australia 4-1, and knack Italy 1-0. Dem dey enter dis knockout stage with full confidence and dem never lose game for Chile. But Nigeria Flying Eagles wey finish third for Group B and qualify as one of di best third-placed teams, no dey carry last. Dem lose dia first game 1-0 to Norway, but later beat Saudi Arabia 3-2 with late penalty, then draw Colombia 1-1 to waka enter knockout. Di team qualify after dem finish third for 2025 CAF U-20 AFCON. Dem dey ready to shock Argentina. Possible line-up: Harcourt, Ochoche, Okoro, Daga, Akinyele, Bameyi, Arierhi, Ayuma, Achihi, Salihu, Maigana. Prediction: Nigeria 2-1 Argentina.