Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Flying Eagles of Nigeria dey prepare for one hot Round of 16 showdown with tournament ogbonge favourites Argentina for di ongoing FIFA U-20 World Cup wey dey shele for Chile. Di match go happen on Wednesday, October 8, 2025, by 8:30 PM Naija time. Fans fit watch am live for DStv (SuperSport), StarTimes, FIFA+ and beIN SPORTS.
Argentina don dey para for dis tournament as dem top Group D with three wins from three, dem beat Cuba 3-1, destroy Australia 4-1, and knack Italy 1-0. Dem dey enter dis knockout stage with full confidence and dem never lose game for Chile. But Nigeria Flying Eagles wey finish third for Group B and qualify as one of di best third-placed teams, no dey carry last. Dem lose dia first game 1-0 to Norway, but later beat Saudi Arabia 3-2 with late penalty, then draw Colombia 1-1 to waka enter knockout. Di team qualify after dem finish third for 2025 CAF U-20 AFCON. Dem dey ready to shock Argentina. Possible line-up: Harcourt, Ochoche, Okoro, Daga, Akinyele, Bameyi, Arierhi, Ayuma, Achihi, Salihu, Maigana. Prediction: Nigeria 2-1 Argentina.
Written by: News Editor 1
FIFA U-20 World Cup 2025 NIGERIA VS ARGENTINA U20 round of 16
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025