Real Madrid forward, Kylian Mbappe, don beg people make dem stop to dey talk about di personal lifestyle of Barcelona winger, Lamine Yamal. Mbappe yan dis one ahead of France World Cup qualifier wey go happen against Azerbaijan on Friday night. According to di France captain, Yamal na correct footballer, but for real life, him still be small pikin. As Mbappe take talk for interview with Movistar, “People dey talk too much about him personal life. I feel say make dem just leave am. For ball, na big baller, but for real life, him na just 18-year-old pikin.”
Di Spain international don trend for internet for di past few weeks because of tori wey concern him personal lifestyle. Dem report say Yamal dey run romantic relationship with one 30-year-old influencer, Fati Vázquez, during him summer holiday. Dis matter don scatter online and many people don dey para, but Mbappe don talk say make dem free di boy and allow am grow.