National

Court Don Sentence Three Men To Death For Robbing 87-Year-Old Woman for Ekiti

todayOctober 28, 2025 1

Background
share close

Di Ekiti State High Court wey dey sit for Ado-Ekiti don sentence three people Shadrack Apos (30), Lucky Akpos (33), and Adunola Precious (24) to d3ath by hanging for robbing one 87-year-old woman. Dem arraign di trio for August 19, 2024, before Justice Lekan Ogunmoye on top two-count charge of conspiracy and armed robbery. According to di charge, dem rob Mama Victoria Folorunso for Ifaki Ekiti on June 12, 2024, collect ₦147,000 cash and one wristwatch. Di woman talk say she dey sleep around 1:00 am when two men enter her room one point gun for her head and di other hold plank. Dem collect ₦100,000 plus ₦47,000 wey she hide inside her underwear and even carry her wristwatch. She talk say dem no wear mask and even relate well with her house help, Adunola Precious. Dem later threaten say if she no keep quiet, dem go kidnap and k!ll her.

Prosecutor Kunle-Shina Adeyemo bring two witnesses come court and tender statement, search warrant and wooden gun as exhibit. Di defendants use dia lawyers Oluwatoyin Marcus and Mitchel Aribisala defend themselves, but each only call one witness. For him judgment, Justice Ogunmoye talk say di 3rd defendant, Adunola Precious, na di person wey open door give di robbers easy access to enter di house, so she join for di plan. Di judge say di evidence show clearly say dem all plan and carry out di robbery, so di prosecution prove di case beyond reasonable doubt. He finally find dem guilty and sentence dem to hang by di neck till dem die, as he end am with, “May God have mercy on dia souls.”

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app