National

Lassa Fever Don Kpai 263 People For Nigeria

todayOctober 9, 2026 6

Background
share close

By: Kofoworola Olayinka

Lassa fever don kpai 263 pipo and infect 1,115 others for 24 states for Naija, according to di Nigeria Centre for Disease Control and Prevention, NCDC.

For di agency report wey cover September 14 to 20, 2026, NCDC say dem record 11 new cases, compared to 17 cases di week before. Di new cases come from Ondo, Edo and Taraba states, and 119 local gornment areas don record cases this year.

NCDC say five states  Bauchi, Ondo, Taraba, Benue and Edo na where dis sickness dey for most of di confirmed cases di agency advise pipu make dem keep dia surroundings clean, cover food well and make rat no enter dia house.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds