Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
todayOctober 28, 2025 1 2
Nigerian rapper Ice Prince don open up about di big change wey don happen for him health and how e decide to live clean life before him birthday wey go shele on October 30. For one heartfelt post wey e drop for X (wey dem formerly call Twitter), di Oleku crooner talk say e be like e wan explode no be say sickness dey worry am o, but na bad habits and poor lifestyle choices. E yarn say, “God so good inna me life A short story!! Was literally about to explode.. no sickness (Bless God) just bad habits and choices. But then Chopstix and Dami say ‘make we lose di belly Ice’ and that one just ginger my brain, make I activate.”
Ice Prince still talk how him padi and producer, Chopstix, begin dey come him house everyday for evening walk around di estate walk wey later turn to deep gist and strong bonding moment between di two of dem. E add say, “From that meeting, my brother Chopstix dey come my house every evening after dinner and we go waka one hour. Our talks during those walks na gold to me, just like di ones wey we dey talk since we small.” Ice Prince con round up di talk with better advice as e talk say, “Next year na full chest lol but abeg make una note this one if nature no make am, no take am… Health na wealth!!”
Written by: News Editor 2
Ice Prince birthday Ice Prince fitness journey
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025