Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
todayOctober 28, 2025 14 5 5
New video don surface online show popular Nollywood actress Regina Daniels with one mystery man, and di matter don make social media catch fire. For di trending clip, people see Regina dey step out with di unidentified man, as report dey fly say she and her husband don dey face marital wahala.
Tori still talk say after alleged domestic violence, Regina don move out from her husband house, leave dia two pikin behind. Just few days after she confirm say she don buy ₦150 million house for Lagos, dem sight her again for new video dey waka hand in hand with di mystery man, both of dem dey smile and look relaxed. Di video don cause plenty talk for online as people dey drop different opinion about wetin dey really happen between Regina and her husband.
Written by: News Editor 1
Regina Daniels latest gist Regina Daniels news
todayOctober 28, 2025 3 2
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025