National

Ground Operation, Air Strikes Fit Join US Attack For Nigeria – Trump

todayNovember 3, 2025 3

Background
share close

US President Donald Trump don repeat im threat say America fit launch military operation for Nigeria because of di killings of Christians wey still dey happen for di country. Trump yarn dis one inside Air Force One when reporters ask am if di US dey plan to send troops or carry out air strikes for Nigeria. He reply say, “E fit happen, I dey see plenty options. Dem dey kill Christians in large numbers, and we no go allow am continue.” Trump don also talk for him Truth Social page say he don order di Pentagon to map plan of attack for Nigeria if di killings no stop. According to am, di US attack go be “fast, vicious, and sweet” against any terrorist wey touch “cherished Christians.”

Meanwhile, President Bola Ahmed Tinubu spokesman, Daniel Bwala, don talk say Nigeria still be America partner for global fight against terrorism, but any support must respect di country territorial integrity. Bwala talk say Trump post no suppose be taken literally because “Trump get him own communication style,” and e fit just be way to push for meeting between di two leaders. He add say both leaders go soon meet for either State House or White House to discuss di matter. Nigeria government don deny say jihadists dey target only Christians, insisting say di country no be religiously intolerant.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app