Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos State Goment don launch one new Certified Accreditors Programme (CAP) wey go make residents help report any ongoing building wey dem suspect for dia area to Lagos State Building Control Agency (LASBCA) and other regulatory bodies. Di Special Adviser to Governor on e-GIS and Urban Development, Dr. Olajide Abiodun Babatunde, yarn dis one during media briefing about di 70% stage certification fee wey concern building permit. He talk say CAP agents don already start work and for the next six months, LASBCA no go dey do stage certification, na di CAP representatives go handle am. He add say dis move na part of Governor Babajide Sanwo-Olu T.H.E.M.E.S Plus agenda to turn Lagos into 21st-century smart city. Babatunde still talk say even though LASBCA don hand over part of dia duty to CAP, dem go still dey monitor and enforce rules because shortage of staff still dey affect stage certification.
Meanwhile, Lagos Vehicle Inspection Service (VIS) don finish one three-day leadership and capacity-building training for dia senior officers and zonal heads to boost professionalism and public trust. For di statement wey Deputy Director of Public Affairs, Bolanle Ogunlola, sign, VIS talk say di workshop wey dem tag “Behind the VIO Badge: Transforming Perceptions, Building Trust”, na collabo with Civility Institute of Nigeria. Di training focus on leadership, emotional intelligence, and ethical communication. Director of VIS, Akin-George Fashola, talk say di program na big step to reform VIS and make officers dey show civility, empathy, and professionalism anytime dem dey on duty.
Written by: News Editor 1
LAGOS BUILDING COLLAPSE Lagos State Government CAP initiative Lagos urban planning news
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025