Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Nollywood actress Rita Daniels, wey be mama to popular actress Regina Daniels, don blast her daughter estranged husband, Senator Ned Nwoko, say na im dey behind di arrest of her son, Sweezy. For one video wey surface for Sweezy Instagram Story, Rita Daniels vex scatter as she call out Ned Nwoko, accuse am of betrayal and use of power anyhow. She hold phone for hand dey para, talk say, “You wanted person wey get high star to boost your fallen star. If you think say you fit bite di finger wey feed you, you go fall. My daughter support your senatorial election with $50,000. We cover you make you look like Odogwu, you dey mad.”
For di same post, Sweezy caption di video say, “Dey stress my mama no be your fault. We all go mad. I never see where dem use violence make peace. Pride wan finish you. Drop ego and say sorry.” Tension don dey rise between Rita Daniels family and Senator Nwoko after Sweezy alleged arrest, though wetin cause di arrest never clear. Di matter don spark online wahala as fans dey drag both sides for social media.
Written by: News Editor 1
Ned Nwoko latest gist Regina Daniels news today rita daniels
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025