Entertainment

Blessing CEO Drag Nigerians Wey Dey Blame Rita Daniels For Regina Marry Ned Nwoko

todayNovember 5, 2025 42

Background
share close

Relationship expert, Blessing Okoro aka Blessing CEO don drag Nigerians wey dey blame Rita Daniels for allowing her pikin, actress Regina Daniels, marry Ned Nwoko. Since Regina and Ned marital wahala don show online, some people don dey bash Rita Daniels say she allow her pikin enter polygamous marriage with older man. Blessing CEO come defend Rita, talk say plenty children at Regina age fit rebel and no dey hear word from their parents. She ask Nigerians make dem stop dey blame mama, say: Na the mama naim I blame? Can you shut up! At what age you become rebel? At what age you dey sneak go see man? At what age you get pregnant? We young children dey make poor decisions. Stop all this nonsense.”

Blessing CEO also drag those wey dey mock Regina for lament about her marriage. She talk say Nigerians dey advise women wey dey face wahala for marriage make dem talk out, but if woman finally talk or cry out for help from domestic vi0lence, dem go turn mock am. She share her own story say she self never dey hear word at 15, and even when she decide to marry for University of Calabar, her parents beg her not to marry, but she no gree. Blessing CEO conclude say all dis Regina Daniels gist wey dey trend na example say young people fit make mistakes, and people suppose dey supportive instead of dey judge.

Written by: News Editor 2

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds