Entertainment

Nancy Iheme Don React To Regina Daniels Marriage Wahala, Drop Strong Message For Ladies

todayNovember 5, 2025 44

Background
share close

Actress Nancy Iheme don drop her mind for Instagram as di wahala between Regina Daniels and her husband, Senator Ned Nwoko, dey hot. Even though she no call anybody name, her long post clear say e relate to di gist, as she warn young women make dem shine dia eye before dem marry older men. Nancy talk say many old men sabi play smart and women wey wan marry dem gatz use sense and strategy. She write say, “You no fit marry old man without calculation, especially when you sabi say im be polygamist. You no go climb that kind age gap come dey collect crumbs.”

Nancy still advise ladies make dem no dey see marriage like poverty-alleviation programme, as some old men dey use money take control dia wives. She talk say to marry old man no be work for faint-hearted woman at all. She come urge women make dem always put dia happiness first and waka commot from any relationship wey no dey favour dem again.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds