Entertainment

“Igbo Don Finish Me” — Omah Lay Don Dey Use Glass Now

todayNovember 5, 2025 51 1

Background
share close

Nigerian singer and songwriter, Omah Lay don shock fans with im recent confession about di kind wahala wey im lifestyle don cause for im body. Di “Soso” crooner use im Snapchat take yarn say too much igbo (weed) don affect im health, and e don reach point wey im gatz dey wear eye glass now. For di video wey im post, Omah Lay talk say, “Igbo don finish me. My eyes don go. I no ever think say one day I go dey wear glasses.”

Even though di singer no give full gist, im talk don scatter social media as many fans begin reason di effect of weed and other substances on young entertainers. People don dey talk say Omah Lay matter na reminder say fame and lifestyle fit come with heavy wahala if person no control am well.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

Similar posts

Entertainment

Must Read: 2Baba and Annie Break Up Story

By: Kofoworola Olayinka   Sometimes, love fit real, di memories fit sweet, di children fit precious, but somehow, di marriage still fit scatter for ground. Check 2Baba and Annie Idibia tori from start to finish, you go understand wetin we dey yarn for here and why dia breakup pain plenty […]

todayAugust 31, 2026 10


WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds