Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
One terrible accident don happen on Wednesday for Phototek Junction inside Abattoir community, Jos South Local Government Area of Plateau State, as train jam one tricycle, kill di rider and one passenger instantly. Report gather say di victims die after passenger train wey dey travel from Bukuru to Jos crush dem for railway track. Eyewitnesses describe di scene as “harrowing,” say di train horn dey blow loud and clear but di keke rider still try cross di track. One eyewitness, Mary Philip, talk say, “Di train dey blow horn well well, but di rider still rush cross, and na so di train jam dem kill am and one passenger.” Another witness, Mohammed Ibrahim, confirm say di incident happen around 11am when di train from Bukuru to Jos hit di tricycle, kill two people instantly and injure two women wey be passengers.
Di spokesperson for Jos Railway Station, Adam Abdullahi, confirm di crash and talk say na because di keke rider refuse to stop despite warning from railway officials. “Our officer stop am for level crossing, but he no gree, before train speed catch di keke”. Di dead bodies don later carry commot from di scene, as di area full with sorrow and pain from families and people wey know di victims. Di sad incident don again raise concern about people wey dey ignore railway signs and di need for better safety awareness for di area.
Written by: News Editor 1
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025